E Don Better - Salvation Ministry Choir

Share:

E Don Better

By Salvation Ministry Choir




CHORUS:
E don better for you oh
E don better for you oh
E don better for you oh
This year
(Repeat 2x)

VERSE I:
Oh this year,
You go build your own house
You go marry your own wife
You go buy your own car

Eaahee this year
E don better for you oh
E don better for you ey
Eaahee this year

CHORUS: (Repeat 2x)

VERSE II:
Anything wey dey worry you
Mek you no worry ey
E don better for you oh

This year
Even if na cancer
Mek you no worry
E don better for you oh

This year
Even if na tuberculosis
Mek you no worry
E don better for you oh

This year
Even if na HIV
Mek you no worry
Healing don come oh…

This year
The Lord took your sickness
He took your sorrows
E don better for you oh
Eaahee this year

CHORUS: (Repeat 2x)

VERSE III:
If you dey look for pikin
Mek you no worry
E don better for you oh

This year
The Lord gave to Sarah
He give to Hannah
E go give you your own oh

This year
He give to Elizabeth
He give to Rachael
E don better for you oh

This year
But seek you first, the Kingdom
of God
And His Righteousness
E go better for you
I say
seek you first, the Kingdom of God
And His righteousness
E go better for you

CHORUS: (Repeat 2x)

VERSE IV:
My brother, my sister
It is time to make room, at the top
You must live to put on alone
It is too prodded, it is too distractive
Before you know, you don loose every thing. chai….
At the top, na so so wonder dey happen oh
Na so so blessings dey come from`every corner
This year na your turn to reign
Na plenty packages na him surround you

CALL AND RESPONSE:
Call: Success
Resp: Na you get am
Call: Good job
Resp: Na you get am
Call: Promotion
Resp: Na you get am
Call: Admission
Resp: Na you get am
Call: Husband
Resp: Na you get am
Call: Wife enko
Resp: Na you get am
Call: Good house
Resp: Na you get am
Everything na
jara

CHORUS:(Repeat 2x)

VERSE V:
Doctor don give you
So many many report
E tok say; you no gu fit get pikin
Because you don get, so many complications,
Wey don revolve to damage for your systems “Imagine”

E tok say; na HIV 1 & 2 you get
Na so so yama yama result e dey give you
My brother, tell me which report you believe?
If I be you, na God’s report I gu believe
God’s report say, e don take away your pains and your shame and nail them on the cross
If you took it, then you don have it
Beause, took na took
I say took na took

CHORUS: (Repeat 4x)

Sing till your Spirit is filled with the Spirit of God.

No comments